Maverick and popular singer
Daddy Showkey, expressed his candid opinion this morning concerning leadership
and politics in Nigeria and why Gov Okorocha will dare have a Zuma statue in
Imo State.
Read his unedited words
below...
My people make me una hear,
this one surprise me oo. What is it that when someone wants to contest for a
seat in the government concerning someone in power, that is when the person in
power will be using the government’s might to dugout the past of the person who
wishes to contest for that position. And these same people was used by the
person in power when you were campaigning for your seat in power. If you knew
that they were bad, y use them in first place.
Now for the same government,
sombodi dey build statue wey e no concern the country at all. Abi una don hear
say dem build Sam Mbakwe statue for South Africa? Wey be the father of Imo state.
Imo people dey suffer, he dey build statue wey e no concern the power. For the
same government, ministers say dem give contract, government say dem no give
contract (NNPC) the minister house catch fire burn.
For the same government
road no dey to reach the only international port wey we get for Nigeria. People
wey dey import goods no fit carry their goods after clearing comot from port...
for days, for weeks, for months (Wharf Apapa port, tincan) . Na Ajegunle people
dey suffer because trailers don block all the road wey Enter Ajegunle and Apapa
G.r.a.(wey be one of the most beautiful g.r.a before when we dey grow up, we
dey call am European quarter)
Today, no road because all
our bridge trailer don block am finish on top ijora bridge. Until the day when
the bridge collapses and kill people na him dem go talk.
Now wayo Rochas dey build
statue wey e no concern him people, him government workers wey him never pay
money. Since when him dey as governor, local government election him no do.
Nobody talk anything, sidon(sit-down) look na dog name. My people we go dey
Sidon look? If we talk, dem go go dig our past.
Me as one person, I don
tell una before day for the streets of Ajegunle dem born me. If u like go dig
my past because I don tell the world about my past before and I dey bold to
talk about my past. How many of una fit do am, now Nigeria Na our own, Na the
people own, Na One Nigeria. East-west-North and south, our people dey suffer.
We dey look una oo and we
go soon ready for una #showdonshow #daddyshowkey #lionclan #ajegunle
No comments:
Post a Comment